The founder Sotitobire and 5 others sentenced to life imprisonment

 

Sotitobire: Court sentence Prophet Alfa Babatunde to life imprisonment say e guilty of child kidnapping

High court for Akure Ondo state south west Nigeria Court don sentence Sotitobire Prophet Babatunde and five odas to life imprisonment afta dem find am guilty of child kidnapping.After and before Prophet Sotitobi and his church workers in court

The founder of Sotitobire Miracle Centre Prophet Alfa Babatunde bin dey face accuse of child kidnapping of one one-year-old boy, Gold Kolawole wey miss from im church last year.

Justice Odusola sentence dem afta e find dem guilty of di two-count charge of kidnapping and aiding and abetting to kidnap based on di evidence di prosecution present.

Di Prophet and six oda members of im church bin don dey trial for months afta Kolawole Gold disappear from di Church children department during a Sunday service on November 10, 2019.

0/Post a Comment/Comments